Joke Of The Day: Who Wan Die? (Hahahaha)

WHO WAN DIE?

Police: Paaarrk! Wey ur particulars?

Shifu da chinese pastor: Here they are.

Police: They are incomplete.

Shifu da chinese pastor: Check them well, they are complete

Police: Do you want to teach me my work? By the way where you dey come from by this time of the night?

Shifu da chinese pastor: I go burial

Police: Who die

Shifu da chinese pastor: Na one Policeman

Police: Wetin kill am

Shifu da chinese pastor: He collect juju money from one driver for check point and him hand come swell he come die.

Police: Na your friend?

Shifu da chinese pastor: No

Police : Your relation?

shifu da chinese pastor: No

Police: Wetin you come go do for the burial?

shifu da chinese pastor: I go remove the money from the dead man hand.

Police: Wetin concern you for the matter

shifu da chinese pastor: Na me be the native doctor wey do the juju

(The policeman was staring at me now)

shifu da chinese pastor: Oga police, I beg I don tire, make I find you something make u let me dey go.

Police: Police is your friend, we no dey collect bribe again. Have a nice day.

shifu da chinese pastor: Thank you same to you.

Don't laugh alone kindly hit the share button below!!

No comments:

Post a Comment

© Copyright 2021 Primebrains Media